Wetin man pikin go do Them say education na di best legacy Man pikin go read book Work work e find tire Them de ask am ‘’who is your father’’ Man pikin use him certificate begin sell akara Even akara no sell Nobody wan chop akara again Na meatpie be oga now Man pikin say okay E turn landlord for road Begin beg for food chop People cos am,Man pikin you be ote. As man pikin taya, e carry gun E do, e do, money begin enter Friend way plenty pass garri Man pikin begin get, e turn king. When olopa go catch man pikin All the friend them tear race Them say but why Why man pikin no go sell akara.
Sharing Thoughts of Curried Rainbow.