Wetin man pikin go do
Them say education na di best legacy
Man pikin go read book
Work work e find tire
Them de ask am ‘’who is your father’’
Man pikin use him certificate begin sell akara
Even akara no sell
Nobody wan chop akara again
Na meatpie be oga now
Man pikin say okay
E turn landlord for road
Begin beg for food chop
People cos am,Man pikin you be ote.
As man pikin taya, e carry gun
E do, e do, money begin enter
Friend way plenty pass garri
Man pikin begin get, e turn king.
When olopa go catch man pikin
All the friend them tear race
Them say but why
Why man pikin no go sell akara.
Simply nice and true!
ReplyDelete